Family Time
Erigga
3:43Oh na na na na omo it's paper boy you know the voltage nah It’s your boi Erigga paper boy and Graham D baba Omo e get wetin play when ah go Accra recently mehn Ah no fit yarn am so ah gats put Ah gats express am through music you understand About my guy Okiemute Okiemute say like this he wan go join HK For Accra nothing dey him hand only 10k Eribaba believe me ah nor be JK Before ah waka we fit gather smoke your SK As we dey smoke ah tell am say na Akanuche E work for me nor mean say e go work for Uche He say Erigga lock up who I wan follow pench Na my real guy beside ah dey expect one cash On he way to Lagos he receive alert Family land na he sell the boy too get heart Enter Accra he guys dey hail am Bossu He nor dey hustle every night steady bottle If dem wan cook for house nai him dey go withdraw Small small big man for Accra don poor Nobody tell am around 10 o’clock for night Dem send am message lock gate fling him things outside Because e work for Mr A like that No mean say e go work ki for B like that Because your friend travel go Ghana en make him money You think say if you travel you go make am too Use your sense waka no be leg The hustle wey we dey so na God abeg If not for the streets boy for dey beg Na only God fit to change leggedis to Benz Akaraka di iche Akaraka di iche Weluche gi ga ije oooh no Every mallam with him kettle And every body with him grace Akaraka di iche Akaraka di iche Weluche gi ga ije oooh no Every mallam with him kettle And every body with him grace According to brother Shaggy Oyibo talk say patience na virtue is okay thank you The same kpo wey we smoke write better music Some other artiste smoke am wetin dem sing stupid Are you feeling me or should I repeat No be everybody be your man inside this street Boy don fall person because of yeye pick up For my present police throw am for pick up Okiemute come area we ask am wetin sup For like 2 days ah swear my guy no gree talk Only to hear say he say where dem carry am go Dem give am knife shook mirror but nah him mama show He say he nor fit use him mama na him make am discharge Say around 10 o’clock for night he enter road come Lag Forgetting say everything wey dey happen for Accra Area don hear the real gist ah wan laugh belle scatter Because e work for Mr A like that No mean say e go work ki for B like that Because your friend travel go Ghana en make him money You think say if you travel you go make am too Use your sense waka no be leg The hustle wey we dey so na God abeg If not for the street boy for dey beg Na only God fit to change leggedis to Benz Akaraka di iche Akaraka di iche Weluche gi ga ije oooh no Every mallam with him kettle And every body with him grace Akaraka di iche Akaraka di iche Weluche gi ga ije oooh no Every mallam with him kettle And every body with him grace Omo nah so e just be mehn Which day here ah say Okiemute for Mega Chicken Ah dey call am he dey dodge dodge Ah nor understand this guy e nor dey e nor dey Who naked nor dey shook hand for pocket Nah real matter be this mehn Another problem with our young boy be say dem go dey compare their one step to another man one hundred step real matter my guy If you no get money no hide your face ooh Show your face make person help you Na so life just be na so life just be