Wayo In-Law
Prince Nico Mbarga & Rocafil Jazz
7:59Rocafil Jazz presenting you Sweet mother Sweet mother, I no go forget you For dey suffer we you suffer for me, yeah Sweet mother, I no go forget you For dey suffer we you suffer for me, yeah When I dey cry, my mother go carry me She go say my pikin wetin you dey cry, yeah, yeah Stop stop, stop stop, stop stop Make you no cry again oo When I wan sleep, my mother go pet me She go lie me well-well for bed She go cover me cloth say make you sleep Sleep sleep my pikin oooo When I dey hungry, my mom go run up and down She dey find me something we I go chop Sweet mother, eeeeee, sweet mother oooo, eee When I dey sick, my mother go cry cry cry She go say instead wey I go die make she die She go beg God, God help me, God help me, my pikin oo If I no sleep, my mother no go sleep If I no chop, my mother no go chop She no dey tire ooo Sweet mother, I no go forget dey suffer wey you suffer for me yeah, yeah Sweet mother, eee Sweet mother, oooo, eee You fit get another wife You fit get another husband But you fit get another mother? No When I dey hungry, my mom go run up and down She dey find me something we I go chop Sweet mother aaa, sweet mother oooo, eee When I dey sick, my mother go cry cry cry She go say instead wey I go die make she die She go beg God, God help me, God help me, my pikin oo If I no sleep, my mother no go sleep If I no chop, my mother no go chop She no dey tire ooo Sweet mother, I no go forget dey suffer wey you suffer for me yeah, yeah Sweet mother, aaa Sweet mother, eee, ooo Sweet mother, aaa Sweet mother, eee, ooo