The Woman With The Issue Of The Blood
Bro Ifeanyichukwu Onyeachonam
There was a woman That was sick with the issue of blood For twelve good years This woman have been suffering oo No solution o, No solution My bible tell me say She done suffer so many things for many doctors hand When she goes to one native doctor them go tell her say make she killi goat She go go for another native doctor o them go tell her say make she killi fowl doctor tell her say dem nor know the name of her sickness o Not to talk of to know the cure Everyday her problem dey increase everyday This woman done go for fake prophet hand Prophet tell her say them go naked her bath her for river o Them naked her, them bath her for river o Them tell her say make she go lighti black and yellow candle o She lighti black and yellow candle finish o Everyday her problem dey increase everyday This woman done suffer many things for this life... Just to make sure say, healing go come. Em Mama run, em papa run. Sister run. Her husband run o Everybody wey she get run away from her o People tell her say Madam u dey smell o This woman done sell all her property. So tey say na only one wrapper na remain. Only one! She go wash am for night Tie am for morning o Everyday her problem dey increase everyday o She go lie down she go come dey cry o She go say God! Which kind wahala na be dis. Aooo! Why you create me at all o daddy! Why my Mama born me at all o So one day she hear say Jesus dey pass o Nai she talk say I want to see am o Main while she done dey hear Of many good things wey Jesus dey do for people o People tell her say Madam you nor go fit see am o Because that Jesus na very busy person o And you know, u know say u dey smell o This jesus he nor go get time for you o The woman say. I just believe o I just believe say na only me go see am o And wen I go see am, na only touch I go touch am o Bcos if I touch uria ria no ria mu ka la She say... If I touch Uria ria nor ria mu ka la If you touch me Uria ria nor ria mu ka la E'me ti wo ni we yakah Uria ria nor ria mu ka la... Uria ria nor ria mu ka la. When the deal day came my people The Bible say... The crowd was too much o This woman she began to struggle o As she dey struggle dem push am commot o She took another step of faith She came timing she came pressing and she came calculating o As she was coming people began to give way for her People began to give way for her because of her Odour o I say your wahala go bring breakthrough for you Hallelujah. I say your problem go bring breakthrough for you Amen. This woman she came timing... She came pressing o and she came calculating o When nobody was expecting She matched forward And that place. She grabbed the master's wrapper From that minute, the pool of blood dried up From that time Uria ria nor ria ya alah E'me ti wo ni we yakah Uria ria nor ria mu ka la Ah!. Uria ria nor ria mu ka la. E'me ti wo ni we yakah Uria ria nor ria mu ka la Aaaaaa... Uria ria nor ria mu ka la I nor know weytin you dey pass tru for life Anything can be your ria ria le oo Poverty poverty can be your ria ria le o Bareness can be your ria ria le So tey say if u dey pass for road People go dey describe you with the problem wey you get... Dem go say... You nor know so so dat brother Wen e be say na so so so na problem na dey follow am o Dem go say. You nor know so so that sister Wen e be say na so so so dat problem na dey follow am o You were not born to be a problem carrier o If you can touch Uria ria nor ria mu ka la E'me ti wo ni we yakah Uria ria nor ria mu ka la o If u touch, your sickness and your wahala go go Oga business man. Your sickness and your wahala go go Market woman your sickness and your wahala go go Oh! Students you dey hear me... (Your sickness and your wahala go go) Teachers you dey hear me... (Your sickness and your wahala go go) Oga lecturer you dey hear me... (Your sickness and your wahala go go) Business man you dey hear me... (Your sickness and your wahala go go) E'me ti wo ni we yakah Uria ria nor ria mu ka la You just need a little Faith A little faith...